Welcome

Una welcome enta campaign wey men dem dey, d thing give me joy as I see say na two Nigerian get the two slots. Our progress for the forum dey give me joy. Everywhere we dey, na so e suppose be. Funny say two of una PM me after una apply and na two of una get the slots.
Lol... You nor sabi sey na the oil wey dey ya head we take style come tap no for dat chat 😆
My broda, I really dey surprised too sey I make d cut. Who I be if nor be Baba God wey make am soft for me. I dey happy too sey anoda correct guy follow me enta. Shout out to Pokapoka! And to all oda compatriots wey dey here I twale for all man. Even the pms wey I don get unto dis matta ehn e show me sey we dey share luv here. One luv my people! Persin wey get Una get something wey pass bubu. Sorry sey I just dey post now, e never reach 30mins wey I enta forum. Offline busyness worry me today nor be small. I thank all of una wella!