Welcome

Una welcome enta campaign wey men dem dey, d thing give me joy as I see say na two Nigerian get the two slots. Our progress for the forum dey give me joy. Everywhere we dey, na so e suppose be.
Omo, e shock me too say na 2 of my naija brodas, collect 2 slots way pop up but, I no ho like say e shock me shah via say, the kind work way we dey do hear, no be small something.
Them say, pikin way no get plenty cloth, e no dey follow rich men children dey play for sand. That be say, we understand where we come from and we know how e be so, no time to check time. Na steady on the work make we for dey grind las las, make everywhere for burst.
I dey see normally when them collect people for campaign but this one special scatter. Make una chop nnunu, we dey together for the matter. I greet una, hustlers.