Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigeria Local Board, All board discussion welcomed. {No Official Language}
by
Gozie51
on 10/09/2021, 10:25:27 UTC

Anyways who see bubu swagger with dat trouser wey e wear, d tailor suppose go prison make I no lie, a whole president see wetin dey give am war. This man just dey spoil our country name everytime.


Yes I see am, the swagger no be here and bubu posture make matter worse, the thing come cast his long frame as if na crime to dey tall. Well I think say bros hope uzodinkma for arrange the top wey be Ibo attire long enough to cover the trouser like babariga, that one for cover all our Nigerian shame inside the clothes. That one still fit make make worse because him for still be like tree wey dey waka.

But on serious something, make we no forget say bubu na muslim and dem no dey sew trouser wey dey reach ground. My mind dey even think say bubu reject the normal and usual trouser wey dem sew come first. Grin Grin . That trouser fit be his own prescription, we sabi say bubu no want no wetin anybody dey talk as far him think say for him mind him don do correct thing wey make the kontry be as we dey see am ?


Also wetin una reason for wike talk, say make we all dey on our own. I hear the northern been destroy beer and yet dey still wan they recieving der percentage for wetin the company's dey pay for this side them dey reside. Tori just plenty for town this weekend.

Bros abeg northerners no comot mouth for beer oo. Them get their sabo gari area wey dem dey flex, na who dem catch go collect. I dey really feel wike, although na because him too no be APC