Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigeria Local Board, All board discussion welcomed. {No Official Language}
by
CryptocurencyKing
on 12/09/2021, 10:55:34 UTC
Majority is differ from all so I'm not saying all youths are Scammers, some are legit hustlers and yet some are yahoo boys I'm just saying the whole yahoo thing is getting out of hand, too many people are doing yahoo for real, I'm not guessing it's what I see around me, people no dey hide am, do you know why EFCC storms high land? I'm telling you right now that EFCC are paying to Burst yahoo boys, this also is confirmed by me because I'm very close to them

Scammers are now even cashing out with BTC, this is latest and fact this na something wey I see, Nigeria need some cleansing to do I swear I don't know how to confuse you guys, my own worry is just the country's future, we know say things hard but no be Nigeria poor pass, them say our children are our future but if them all do what their mates are doing shey it never finish?
Them say house way them no build on better foundation, say e dey fall. E fit be to you like say, Nigeria dey fall but, maybe no be the youths fault. Scamming no be better thing o but, na where some people don see road make them for see food chop. Reason am na, before the advent of G-boys for we kontry, EFCC never been dey? E don tay way this EFCC people been dey but, as them no sabi do there work, as Ibori looting case take long way be say, them no dey prosecutee any serious thing, as you go hear say, them catch person and you no go hear any other neslws say them prosecute the person with the law, e don make bois dey do plenty to survive.

Every year na so so change and change, yet nothing. No body dey question anybody for fulfilment of campaign promises, person go prepare budget with budget deficit way go be excess and unforseen expenses and yet, them no go complete the project. Some days ago, I see some youths dey paint Road in preparation for governors visit! Na to telle say, na that time them found the project? Abi na to cover up money way them don chop tay tay...

I no blame them for watin them dey do. As them no fit carry kala like them herdsmen and bokoharam way dey receive sponsorship from this same persons way dey vex for youths, dey call them lazy, na why th gat use the small sense way them get enter online dey fine maga. These na people way suppose dey receive sponsorship for tech trainings and other forms of production for the country. If you open small chop cef, na so tax force go carry bill finish you. The wahala too plenty but any which way,

We say no to scamming, the life no sure!