Just because everybody no go succeed no me say u no go try. If you see small small children wey dey make money form NFT, you no go discourage anybody form trying. Don jazzy which day back just make $300,000 in 10 minutes from NFT. When the likes of Disney, Pepsi etc already they create their own NFT who be you to not join the trend if you get some knowledge on how to run am.
Boss for this life ehhh I go dey always dey respect you opinion because wetin you dey always yarn get enough wisdom person fit gain from, but boss make I break am, I never talk say NFTs no be the real deal and yes for sure e dey profitable, look the name you call, Pepsi and the rest these are major brand, and already has been selling for many decades so if they carry that kind influnce wen dem already get omo NFTs go now na and as for the other small children they no small at all them better innovative ideas them sell out and no be everybody they one firat the innovative ideas so go just jump inside the NFT something because they here say e dey profitable