However, d ish wey I raise na d use of translator. I sure sey I don read am here wey some DT members frowned at it. I nor fit trace that thread now. But persin nor supposed dabble into wetin im nor sabi handle in order to deceive others na.
I understand you well brother, Make we make point clear oh nobody dey encourage use of translation to use communicate, wetin you no sabi comot hand. The translation na only to use understand then you fit reply for pidgin. E no go make sense to dey carry translation talk.
Anyways, na another year be dis abeg as una dey teach/educate people here make una dey bring update too. Anything wey go put money for person pocket wey legit make una update. Nobi only to dey learn learn, man need chop too. After God preach finish e give people bread and fish to chop so if we fit dey do the same e go go well. Make we make this year sweet for this board abeg.