Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigeria (Naija)
by
Pokapoka124
on 06/01/2022, 11:27:58 UTC

Anyways, na another year be dis abeg as una dey teach/educate people here make una dey bring update too. Anything wey go put money for person pocket wey legit make una update. Nobi only to dey learn learn, man need chop too. After God preach finish e give people bread and fish to chop so if we fit dey do the same e go go well. Make we make this year sweet for this board abeg.
I support wetin CryptopreneurBrainboss talk. We be crypto community make we do like one. E dey vex me say newbies way nor even sabi wetin we sabi dey make better dough for the industry. Crypto universe big n we dey learn everyday make we nor be those hypocrites way dey claim say dem enter Bitcoin for the tech.