Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigeria (Naija)
by
igehhh
on 23/02/2022, 13:36:43 UTC
I don dey see your post but I get one comment way I Wan make and he go make sense if you correct yourself to avoid ban, you know say all this people just dey after us,
I don see like two of ur post way be say na only source link you put, abeg incase you copy person post always make sure say you quote the person and always make sure say you add source link to be post to be at a saver side.
I don warn una before especially the newbies here say e no dey necessary to dey create topic If you want to grow your account, contribute positively to existing topics. Forcing yourself to create a topic about which you have no knowledge will always result in plagiarism. There are numerous topics on each board, and if you must create one, make it of high quality.

This kind startup dey hurt person tomorrow because those posts were quoted and dey fit use am against am tomorrow. Abeg we dey support ourselves here and dey try grow together too but anybody wey dey find way to cheat the system dey on his own.



Take your journey in this place very serious because the benefits wey follow too much ooo
No be lie you talk. The benefit yafuyafu. But na for senior men like una e sure pass for. Me self I deh imagine wetin I go deh do with that kind weekly pepper weh una deh get if e touch my hand. Na real enjoyment una deh.
More money more responsibility brother nowhere dey easy, everyone go reach there too.