All of us dey talk one thing, but Charles and Igehh dey reason like say dem no dey dis we country. Dem dey talk like say dem get right base on wetin CBN put for book. Wen you Don fall victim na em you go know say the fight na between government and the people.
Me and my guys don make some dangerous waka for Ph to dodge police, based on say dem dey search people phone to check who get Binance or any other wallet for phone. Say dem ban crypto for Naija. Dem capitalise there suck people dry.
My brother that argument no gree me put mouth again na him make me leave am. I no come understand the one weh be partial abi na implicit ban. Maybe police neva play them tape before unto that matter about cryptocurrency ban or them never get person weh e happen to first hand. You can imagine police checking phones for Binance app as them sabi say most cryptocurrency lovers for Nigeria deh on Binance exchange and somebody deh tell me say them no ban crypto for we country. Wetin be ban again? Na God go deh protect us sha.
Afa!! Senior men for this ends, I been done see were 1 of us caprison say make na must do broke the bottle for here weh we dey, why I come they see professors dey knack Biq Biq grammar ?
Na which level ? broken or english ?!
Na local thread this be. E go better to use pidgin English as that go make sense pass. Those weh deh use grammar get their reason because I no see the reason why. We don reason this matter last year. But as I no be senior man make I just maintain my corner deh watch every.