Na local thread this be. E go better to use pidgin English as that go make sense pass. Those weh deh use grammar get their reason because I no see the reason why. We don reason this matter last year. But as I no be senior man make I just maintain my corner deh watch every.
Me I dey in support of pidgin and English but my problem na say if na oyinbo you dey speak abeg mix am small add am small pidgin so we fit stand say pidgin na our languages Incase if them ask us how far. Just speaking English no go give us strong ground. Na just my own opinion. Secondly as we no dey tool speak English here I noticed when outsider come dem dey give acknowledgment for invading the thread but if na English we dey speak dem go just contribute without any acknowledgement.
Na uniqueness dey make people pay attention to you, make we realized that and do wetin go benefit us. If dem ask you now why you need local board wetin you go talk. Dem fit say the thread no active enough as dem fit read everything wey we dey talk if we dey communicate mainly for English but on how we dey mix am couple with the activity them no go know whatsup.