Hey my people, how una dey?? I sai make I hail una.
My name Nah pouvoirp and i be confirm naija pikin.
I don dey for this forum for some time now and I still be newbie and just dey discover sai Nigerian board dey the forum.
I don dey hear about this crypto stuffs, like bitcoin, nfts, defi, metaverse and the whole matter dey scatter my head, so I go need help of senior men and women here to understand am better. Abeg, make una no vex for my questions because I still be newbie.
I wan thank @CryptopreneurBrainboss for creating this platform. I appreciate your work for this forum and for our Nigerian people for hear.
You are welcome for this our board ni. You do better thing as you come pay homage to senior men and women wey be Nigeria for this board. As for them to know sae, you carry Naija blood and you just enter the forum newly.
You get no cause to worry, if you get any matter concerning bitcoin, nfts, defi or metaverse wey d confused you to understand for Btt forum, we Nigerians wey d for here gat you covered. Wetin you go do, na to bring it up as a topic discussion for this our local board, we go dilute am for you to your understanding.
So chillers and be free. We be one for here