Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigeria (Naija)
by
Fivestar4everMVP
on 08/06/2022, 19:06:25 UTC
As for this government na God go judge them. Buhari don play us like ball finish now him wan pass us to Tinubu or him cousin Atiku. I believe say those APC cabal go still work against Tiunbu for the general elections. Sometimes I dey wonder if our leaders get conscience.
If Tinubu Abi na TiBulu (what ever be him name), if that name by mistake win 2023 election, omo, na serously gbege this country enter ooo, the cry wey we dey cry for this buhari tenure go be small one ooooh, make no body better vote for that man, that man no get any thing to offer Nigeria, they don turn the presidential office of our country to turn by turn affair, TiBulu feel say na him turn to rule, that na why he won answer president TiBulu by all means, make no body vote for that man ooooh.


By the way, how una dey 😁😁
Runaway soldier don come back ooooh. 😄