Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigeria (Naija)
by
Gozie51
on 08/06/2022, 19:22:33 UTC
@Zlantan. Guy you for try find somewhere open thread on top this success story for forum. I check your post and this story no open any thread. The story dey inspiring. Although na we naija the thing teach something more as this government dey us on top bitcoin ishe.

I deh tell you o. Zlantan for enter main forum open thread on top this case as na good one weh supposed even make all our oyibo peeps them follow shook mouth for the matter. E go bring you blessings too, you understand wetin I mean. Na correct happy ending be the gist. These our leaders them own don too much for 9ja. Wetin we do them self, weh them no go let us rest for corner or drink water and keep cup. But I for like know the damages weh EFCC pay the guy. There should be punishment for them.

Na so I think am oo because na good vibes. Me for want take am do story but I look am say e go be like say I dey shoot omo iya for leg , na im make me ask @Zlantan to blow the whistle louder for forum. I read where him say him dey cook something about am. My broda such info na as e dey hot oo since na court judgement, you for comot mouth now blow the thing loud, if e cool the vibes go dey die down.