Since FFK bad mouth Buhari and Apc finish still come join the party, I stop to dey see sense for any thing wey come out from em mouth because I see am as person wey no get integrity at all.
No be only FFK dey on this table bros. This one touch all our politicians for this country. Them suppose to make law wey go make you lose your position if you jump from one party to another. I think with that our politicians go learn how to stay one place and maintain their integrity. Even the ones wey never jump from one party to another dey practice anti-party low key. Dem just dey tell us indirectly say they no care about us but they are after their own interest. We gat to wise up this time.