Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigeria (Naija)
by
uchegod-21
on 20/09/2022, 22:46:07 UTC

Ahh this our God too wonderful I swear. I just land for place and the first thing na to see my people. Hallelujah! Make I follow introduce myself sharp sharp
Username; knowngunman
Gender: male
State of residence: Lagos
Skills: shoe maker
I beg make una no fear my name at least I no be unknown gun man  Grin make person put me through for this new environment please

Welcome Knowngunman, thankGod you know say your name get k-leg. There are plenty name wey jakpa where you go chose from answer but na gunman you see to pick. But na your choice, nobody get right to chose wetin you wan answer. But remember say with the present situation of Nigeria and the activities of gunmen everywhere, no single Nigerian go dey happy anytime wey dem see your name. E go remind them the atrocities wey don happen and still deh happen for the country.

Another thing be say dem no dey change username, unless u get strong reason to do so.