Welcome Knowngunman, thankGod you know say your name get k-leg. There are plenty name wey jakpa where you go chose from answer but na gunman you see to pick. But na your choice, nobody get right to chose wetin you wan answer. But remember say with the present situation of Nigeria and the activities of gunmen everywhere, no single Nigerian go dey happy anytime wey dem see your name. E go remind them the atrocities wey don happen and still deh happen for the country.
Another thing be say dem no dey change username, unless u get strong reason to do so.
No be wetin you dey reason ooo senior man. The thing wey the gun men dey do us this country too much and our goment dey deceive us say they are unknown. So I use the name to serve as memory for the activities cux they're known. Nothing is unknown for this country. If you know the reason why I use the name, you fo no blame me. Dem take my better people away from me. I no just fit forget those sheges.