No be wetin you dey reason ooo senior man. The thing wey the gun men dey do us this country too much and our goment dey deceive us say they are unknown. So I use the name to serve as a memory for their activities cux they're known. Nothing is unknown for this country. If you know the reason why I use the name, you fo no blame me. Dem take my better people away from me. I no just fit forget those sheges.
I'm sorry if the high level of insecurity in the country has affected you in one way or another, if you've lost someone or people because of this gun wielding men, then accept my sincere condolences.
Having said that, if me i wan talk the truth as e suppose be ehn, your username no they send the right message wey you wan portray for your mind, any user wey see this username fit come get the wrong impression about you, and even if users no go openly tell you, for their mind them fit no wan associate with you in any way possible on the forum, but as you don choose am so nothing much, everything fit still go well, Good Luck in the forum.