Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigeria (Naija)
by
knowngunman
on 21/09/2022, 22:18:07 UTC
Na now I understand why you chose the name and e be like say dem don wound part wey pain you. Take heart brother, dis country we dey live on it's own na risk we dey take. For you to wake up everyday dey alive na testimony. But e no go dey like this for ever, God go expose the wrong people wey dey keep this country like this for their individual gains.
The momentum among the youths don dey gather, e no go too tey e go happen and all of us go liberate and smile at last. Make things wey pass no too dey drag you back baba.
Thank you sir, @coyster and the rest for your kind words. I believe we go do the right thing for this coming election. This is the chance for us the youths. Either we make it right or e go worse pass like this which me sef say God forbid. So concerning the Npower stuff wey una dey talk, na just opportunity wey Buhari create for some people to milk the nation's wealth and nothing like empowerment for the youth. Make everybody use his sense this time biko we Don go above their 30k abi how much sef