Welcome Knowngunman, thankGod you know say your name get k-leg. There are plenty name wey jakpa where you go chose from answer but na gunman you see to pick. But na your choice, nobody get right to chose wetin you wan answer. But remember say with the present situation of Nigeria and the activities of gunmen everywhere, no single Nigerian go dey happy anytime wey dem see your name. E go remind them the atrocities wey don happen and still deh happen for the country.
Another thing be say dem no dey change username, unless u get strong reason to do so.
No be wetin you dey reason ooo senior man. The thing wey the gun men dey do us this country too much and our goment dey deceive us say they are unknown. So I use the name to serve as a memory for their activities cux they're known. Nothing is unknown for this country. If you know the reason why I use the name, you fo no blame me. Dem take my better people away from me. I no just fit forget those sheges.
Na now I understand why you chose the name and e be like say dem don wound part wey pain you. Take heart brother, dis country we dey live on it's own na risk we dey take. For you to wake up everyday dey alive na testimony. But e no go dey like this for ever, God go expose the wrong people wey dey keep this country like this for their individual gains.
The momentum among the youths don dey gather, e no go too tey e go happen and all of us go liberate and smile at last. Make things wey pass no too dey drag you back baba.