Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigeria (Naija)
by
uchegod-21
on 23/09/2022, 23:09:35 UTC



This picture and the comment dey make me laugh since and I wan roll for ground self. The person wey reply that thing confuse or e high. The person mean say as dem.born Tinubu him kuku marry from birth Grin
But we know say Tinubu age na scam, but this one no join make sense.

E get some things wey you go see, you go reason say school no be scam o.
I remember those word problems dem dey give us for maths. Like;

If Tinubu is X years old,
The wife is X - 8 years old.
Let the age of Tinubu be 76yrs.
How old will be the wife after 2023 election  Grin Grin

My mate go begin use the data wey dem give for question dey form algebraic equation.
Me I go dey use common sense dey reason the thing Grin