My ppl una good afternoon, Abeg how una take see this matta. As fedral government do talk last time say dey wan ban our lovely kpomo wey dey make dead animals for soup dey brekete just because say dey wan make leather indusrty wake up from sleep. Now kpomo don dey cost for market. Meat & fish no gree make we touch am. How person go dey chop for food and nothing dey to whin teeth and the only better thin wey dey give joy as man dey chop nah des dead animal. Me i don tire (adulthood nah really scam).
Ogo oooo make dey luk the mata becos na watin we fit Buy now for market, the way wen meat dey cos now poor boy like me no go get meat chop now, cow wen dey dey buy for #100000 before come go #300000 more than 150% almost 200% make dey review the mata. Even wen no be for poor man.