Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigeria (Naija)
by
GiftedMAN
on 20/10/2022, 06:40:18 UTC
New Topic: Weti u go do if u bcome di President of 9ja?


One thing to note about politics and power be say e dey sweet and e dey enter head well well. As e be say our country dom tie rapper now, if I become the President of this country the first thing wey I go do na to first equip my security so that bad politicians dem no go kill me then I go ban all the past and present leaders be you minister x commissioner so long as you dom occupy any political office for naija here I go make sure say none of them go get access to travel go abroad for anything until we fix things for naija here then I go come retire all the old papa dem wey suppose dey house wey still dey office then replace them with accountable and credible young men wey get oil for their  head and wey fit contribute positively to the growth of my administration. Once I dom achieve this thing wey be my first agenda, I go come find way to fight and tackle the insecurity issues because na the matter make plenty company run from us go Ghana and other African countries go stay.