Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigeria (Naija)
by
Lida93
on 20/10/2022, 13:07:30 UTC

online screen resolution changer

WATER FOLLOW RUN AWAY FROM ME EYE'S THIS DAY TOO, MAKE THE SOULS OF THOSE FALLEN HERO'S REST IN THE BLESSED MEMORY
  Today make am completely 2 years already.
Na di onli day I cried without cane. Dat day was really sad 4 me. Dat is why I always said dat di problem we have in 9ja na di arm forces and di court. Wen States governors plus federal government do dat, human rights activists carry di mata go court, till date I never hear anything wey di court judgement outcome. Di day wen 9ja go beta na d day wen we citizens nd di gvt go practice di real democracy. Do u kno day when dis #endsars protest was going on, di northern youth was supporting di government. Dat is why sometimes I dey tink if dis country divide sef me I go happy. Because anoda wahala we dey face 4 dis country na di northern youth.  I Kno sae some pipo wey protest 4 d endsars still dey prison. Early dis year, won of the endsars protesters gave birth in prison. Dat means, there r lot of them in di prisons.
God will release Dem dis month nd 4 dose day had died, may God received ur souls. 😭😭 Our past heroes must be remembered
  Ifa remember dis day e dey comot sleep for ma eye. Dat day nai I no say we govment no kia for dem citizens. I no forget wia I watch wen pesin hold flag, soja still shoot am.
 Na God go judge all we leaders wey dey hapi to hide the video of wetin hapin for lekki toll gate and if we Kno wetin good for us, make we all come out vote out dis pipo.
The truth for this matter be say those people wey the government favor them be it youths or elderly them no see anything wrong with the system and administration at the top. And this na one of the major problem wey we NAIJA the face, cos when something wey bad happen and if it favour Mr B. Then Mr B, go support am irrespective of how much the tin d kill and destroy majority or the whole nation. The only time Mr B, go join hand with others the condemn am na wen d bad tins no dey favour am again.

If not imagine the height of killings massacre of youths and destruction of citizens lives and properties and curtailing of all means of development for youths wey this current government dey do, yet many youths, fathers and mother's still d support strongly, why na becos d government favour them pocket and family and as such make other the lament and die nothing concerned them.

The truth be say Nigerians generally na the most wicked humans on planet earth, na only when only wen death don reach them turn to die too them go dey ask for sympathy but for others it's nothing to them.

May God help NAIJA.