all ur comments dey wonder me weda u bi 9ja guy. r u really a nigerian? Or u bi spy in di forum. u kno di kind threats Nigerian army, police mouth on any person wey 4 come 2 say my pesen sef die, oboy use ur head pls. Nigerian army deny say dem no kill anyone but later dem agree say na di govenor send dem.
Oga boss I be confirm naija blood just like you but the only difference be say I dey patriotic to my country
u too much na dis kind toks i dey like bcos e dey motivate me like no other. dem go confirm di ododo, holy ground (nigeria) go cast. di politician don already kno say endsars na warning 4 dem if dem fuck up 9ja youths go hunt dem down. dem dey hope on army and police but di tin go shock dem wen it will happen. REVOLUTION! REVOLUTION!! REVOLUTION!!! Loading in Nigeria. it is half ripe. I can vividly remember a Police Officer (DPO) said something early this year in my PPA. he said, if Nigerian government did not do well the next protest will be stronger than endsars.
You see ba na the problem be this. Regardless of government irresponsibility youth dey among wey dey help make the country worse. No country for this world go make am if the citizens dey pray for the downfall of such country. We must change our mentality and be better citizens. Youths dey kill force men but nobody cares because dem no be human beings abi. The hypocrisy is clear bro. Someone should bring better topic abeg. I don't like discussing again when sentiment and hypocrisy don involved.