Chairman e belike you no know wetin those northern state get for natural resources oh. No be only crude oil be national resources oh there are multiple been hoard by those state and anything wey make the country divide na dem go benefits pass and I no go surprise if them dey thief the crude dey store for them states self.
Many people they think say na only crude oil we get, those Northern states get enough Natural resources like Gold, and na because of all this Natural Resources Bandits they try take over those places. Take Zamfara state for example, they have enough Gold and na why most of them youth they do local Mining to survive and if you look am now those big men wey know how important that Golds are na them they initiate this Banditry just to take over those places.
Also no joke with any state wey be say na dem dey incharge of food oh, if dem cut am e go wey the country. Dem fit use that food as a source to generate income for themselves and if them put head for ground e go go well. But no because dem know say FG go dey give them free funds from sucking the South South so their farming dey limited.
If to say Government of dis our country they try, all this issues we no go de get them; Imagine those states wey they very powerful in terms of farming, na dem de provide some good percentage of d food wey we de supply for d country, but this Government self no they security wise as farmers now de fear to go farm because of insecurity which is not good at all. We need to Change this Government entirely.
Bros, I agree with you. People wey don travel go the North-east, North-west, North-central parts of Nigeria go sabi say one thing wey God almighty use take bless them over the southern parts na better arable land. Shey una remember the time wey onions cost like say na dollar because that time dem block the north-south routes? Abi na yam we wan talk about? And lest we forget, Agriculture na the new oil. If them cut them of na hunger and famine be that.
Anything wey concern food for dis country God don already bless North with am because dem get enough land to farm.
This country need unity so dat we go be one and to supply food no go be issue again because we strongly depend on each others dis country.