Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigeria (Naija)
by
knowngunman
on 21/10/2022, 19:06:20 UTC
Chairman e belike you no know wetin those northern state get for natural resources oh. No be only crude oil be national resources oh there are multiple been hoard by those state and anything wey make the country divide na dem go benefits pass and I no go surprise if them dey thief the crude dey store for them states self.
Kogi state becomes first northern oil producing state, receives oil allocation
As we dey argue on which region to survive after Nigeria break up which we no pray make happen, southern people dey boast of producing oil wey make dem advantageous over Northern people. For some time now northern people Don discover oil too for dem regions but adequate machinery never dey in place to make the oil dey useful. But today the report Don scatter for internet as kogi state Don officially becomes oil producing state for northern region. I believe say na the beginning be this because other states dey road dey do surveillance. Na double win for Northerners now as an oil producing states and food producing too. You go like read more about the update? Oya na the link be this kogi become first Northern oil producing state