Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigeria (Naija)
by
Gozie51
on 22/10/2022, 22:16:18 UTC

Whatever those ones get na for small quantity them deh. You no go fit compare am with wetin crude deh give na. And oil touch everybody. No be everybody deh like wear gold but na everybody deh use petrol. Even if you no use kerosene or gas or any other crude oil produce, you must use petrol.

Na true talk wey you talk. Petrol na wetin every naija dey use and even the oyibo pepo self wey dey build electric cars never fit abandon petrol cars, this one na to show us how important petrol and the byproducts dey and to shop how the world take dey trapped on top petrol matter. Despite say solar this and that dey come out but petrol still never comot for market. For naija now, to run confederation system like as e dey before no go dey easy where every politician eye now dey for oil. Abi na aboki go want go back to kolanut era abi na Yoruba go want begin cultivate cocoa. Every of them fit sell their house make dem just enter there.