Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 1 from 1 user
Re: Nigeria (Naija)
by
Maestro75
on 21/10/2022, 07:39:45 UTC
⭐ Merited by Gozie51 (1)

And some youths weh witnessed the whole thing still deh get mind deh support this APC government because of wetin them want to chop from the government. My prayers na make God reward everyone according to who them support for this election. People weh deh healthy and fit to walk they beg a man weh no fit stand on his own to lead them. No be juju be that?

When I even see di poll Bossman created here for us to know who is who I was even surprised to see someone here dey vote for APC.
And these people are also angry of what happened in #endsars oo. Is it not a pretending ones. Dat is an irony.

Those ones na them be the real problem because their pretence no go let you know their real intentions. You see say no be money issue true true. That person weh you deh talk no go say na hunger make am deh misfire like that na. Abi e get any senior rank person here weh go say hunger deh do am? No na. Everybody weh deh that rank can afford wetin them deh eat but na greed go fit make a man begin talk any how just to support a bad politician. That person deh shameless. See how inflation don finish us and somebody weh know wetin deh get mind deh support APC weh don fail woefully and still want a sick man to replace another sick man. This one no good na.

Make states deh control their resources but pay taxes to FG no go fit work because the north weh e deh benefit well well no go gree.
Chairman e belike you no know wetin those northern state get for natural resources oh.

Whatever those ones get na for small quantity them deh. You no go fit compare am with wetin crude deh give na. And oil touch everybody. No be everybody deh like wear gold but na everybody deh use petrol. Even if you no use kerosene or gas or any other crude oil produce, you must use petrol.