Having said that, no be today we begin yarn about this refinery matter, na the same way we don they complain about electricity issue for decades now, sometimes i they wonder how a blessed country like Nigeria in 2022 still they struggle to supply their country people steady light, at least for 20 hours a day, e bad no be small my brother, i they pray make 2023 be the turning point for us in this country.
When e comes to electricity, e get one issue i dey see as our problem. How dem go track this light and get the revenue to dey maintain the light. Even for the places wey dey get light small we dey see as people dey work over the light and dey get free electricity either by bypassing some appliances or illegal connections. Na this problem follow why e go hard for we to get steady light for nigeria in general.
As for the warning to lagosians, me dey wonder self say dat side never flood. Like how, I no understand. I been think say dem go dey surface d same thing by now. But na wah oh, instead of the government to find solution, na warning dem fit give. Wetin dem dey do with all the revenue wey Lagos state dey generate. If dem never get solution for other areas atleast Lagos state for get some counter measures for flood.