Post
Topic
Board Other languages/locations
Re: African Proverbs in Pidgin
by
Majestic-milf
on 25/11/2022, 02:18:26 UTC
Proverb: Even if goat get frown face e no go lack buyer for market
Naturally, na sheep dey like smile from time to time. As for goats, dat wan na original frowner.

Proverb: Who dem give quit notice no dey pack for daytime
Nor be lie, bro. Especially if him come get people wey im dey owe money for dat area.

 Our oga I greet oh. you scarce like fowl teeth. E no good make you knak us beta proverbs make we take colele our body dis weekend? As we dey wait your own, I say make I keep dis one here.
 
Proverbs: person wey naked no dey put hand for pocket
Meaning: You only give what you have