Omo, like dis everybody dey para for the redesigned naira notes. But wetin I Kno be say wetin don happen don happen. We dey lament say we govt corrupt and all that, but e no go change the fact say the naira dey lose value on a daily. Sombodi say wetin e go profit the naira if e gain all the redesign and lose e value?
As it is, the power to change all these confused geriatrics from power na with our vote. Imagine person go dey whine me say e use not #8bn as was meant to believe but #218bn just to achieve a bunch of turd. So e go beta if we all calm down and think if ways to make the contri beta.
People neva start to dey para, e go soon happen if things dey go like dis. Everything 4 naija na shame and d old bunch of leaders wey we get no go tire or let beta people reach there if people no do something. APC get nothing right 4 their 8 years reign, no be even d mere redesigning of naira note. D thing be like photocopy 4 my eye, photocopy wey dem con mix with colour. This is shameful! I wonder how dem go dey feel if oyinbo people con Naija con dey spend the photocopy...lol. Seriously, I tire 4 dis country.
According to our leaders their intention no be to redesign per say , but say their intention na to bring out money wey people done hide, so that it will be in circulation, as me I see the color of money I was like what is this if that is truly their motive not bad at all because money wey people don hide no be small oh my brother so make we try look this thing for another dimension, and CBN have lifted all deposit charges so abeg if una get old money make we try carry them go bank.