Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigeria (Naija)
by
CryptopreneurBrainboss
on 27/11/2022, 17:53:39 UTC
This recent flood wey happen one commissioner die for Bayelsa due to Cardiac attack becos say e hide money inside room  before e go carry him family go Abuja for safety from the flood,for Abuja na e him hear say flood don reach e house before e go come back to Bayelsa flood don dey window level of e house,all the money don cast. Na wetin lead to him death. So the redesign go help small

I for dun talk 'good for am' but we no supposed they cursed the dead instead wish dem safe rest. So RIP to am but na this kind news dey make me hate the politicians more. Imagine, first him carry him family run while others are left to die in the flood but God no shame him people. I understand say this small small politicians no get much power but if them all join hand, dem fit make the ogas at the top they reason their people and nobi to the hide the money dey chop only them.

We dey lost for this country aswear, I no dey denied the fact say the redesign of the Naira go dey very helpful in combating money laundry and other stuff wey plenty to list here but after them launched the new Naira, will those crimes stop so this new Naira no lose e value too as the previous one.  Any new innovation dey for pipeline wey the government wan launch wey go help the economy or this one na just for another bragging right say na me change the Naira.