Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigeria (Naija)
by
Frankolala
on 29/11/2022, 11:18:54 UTC
Anyway for all my people wey dey Lagos and Abuja looking for job's to use survive and hold urside, make una follow this link for daily legit job updates wey Dem the drop both on Whatsapp and telegram too. It bad say person don finish school but no beta job yet but for now make we de manage the little ones we see for a start na so life for we country just be.
https://chat.whatsapp.com/LfUMpz165EcCNrO1kQUkdd

Buh sorry o if just come chuck mouth like that, how e be say pipo wey dey here go still dey cry for work because as far me know be say no government work go fit kip you as here dey kip you, no pressure or command or even to trouble you self. Here na to just strikely adhered to rules and regulations and everi tin go soft for you all less say you no get better rank here if not here pure wella.
Omo guy no go dull yourself o which kind work you dey find,wey u don already get sure work,I guess say una no dey see say offline work no get security and guarantee becos I don see say time dey come wey civil servants money no go fit meet up with their demands due to bad government and inflation.

The way Nigeria be now na only foreign currency go bit balance your spending so me I no want come dey suffer under sun dey find valueless naira. My advice be say as u dey collect your campaign money just try invest am into business even though na small scale business, you go see say, if u sabi the business you go make am from there as the self made Boss. Anyway thanks for the link and information because e go help our friends,brothers or sisters wey dey find work,since we go give dem the link make dem apply.