See ehh naturally self me really like the update wey be say all those money wey those criminal them loot go waste based on the new rules wey them set and like this any careless move na efcc straight go knock for their doors so e no too dey pretty cool with politicians. Although them fit still disposed all those money wey dem loot though because them get connect onto say them go still carry B'Van enta where them hod am go bank pay put into one business account say na contract be that na so e be and no case.
That na if the money dey with them in cash and even if na cash cef, make we no forget say, these guys na crooks them be and them sabi fine back doors to carry archive watin dem want. The favour for favour still dey play amongst politicians, the foreign exchange market fit still play role, investing it in business, buying shares fit make them clean and them fit still dey recruit people, split am in bits for them to dey deposit for bank, collect percentage and collect back there money in new notes.
The only matter way this printing of notes fit bring for them be say, e go make them think, put them through procedures to clean there money else, e no solve anything. Them go give person project with budget deficit and yet, the person no go compete the project yet, them no go hold them accountable... na now them qan form sense. Nothing come out!
I remember that song: organize! Oh Every other person organize, over wise every other person over wise! Lolz.
The tin be say when it comes to looting peddling of financial corrupt practices our politicians them dey always dey organized among themselves irrespective of party affiliation. This laws Dem wey follow the change of this new naira notes go only hold who no know road inside we country. Cos las las even the efcc boss no go fit reject RBS wey com board into his hand in billion just to cover a politician track of corrupt record.
This country we're good in making better laws but epileptic in keeping them naked to the truth. May God help us all.
Anyway for all my people wey dey Lagos and Abuja looking for job's to use survive and hold urside, make una follow this link for daily legit job updates wey Dem the drop both on Whatsapp and telegram too. It bad say person don finish school but no beta job yet but for now make we de manage the little ones we see for a start na so life for we country just be.
https://chat.whatsapp.com/LfUMpz165EcCNrO1kQUkddWeldon, you don try well well. You see this country as Dem call am naija, the stage wey edon reach don pas dagbaru. I just believe say this country na dagbo we dey see so. Na who wey Sabi road dey survive for the country so. Na only baba God go fit rescue us. You see ehn, if the youth go stand up for this election wey dey come so next year 2023, things go better but if the masses decide to make the same mistake Dem make Oda years election past, omo, na on your own o. Las Las all these things wey dey shele for we country don supposed teach us get sense small. All these our oga at the top no mind as them dey claim party party o, Dem know themselves finish na just our youth I dey pity, dem go fight themselves finish for the oga Dem wey no even get plans for Dem. E don reach wey we go tell Dem make Dem carry their akaya Waka commit for gomment. We Don tire for them abeg.