Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigeria (Naija)
by
Agbe
on 29/11/2022, 21:55:56 UTC

I agree with you bro, Nigeria Politicians dey thief money dey hide for house,inside coffin, inside well,sucker well and even bury money. Imagine  wetin dem dey do our economy. Money wey people suppose to dey use for business so dat e go born children,na e dem imprison cum make people dey suffer. This recent flood wey happen one commissioner die for Bayelsa due to Cardiac attack becos say e hide money inside room  before e go carry him family go Abuja for safety from the flood,for Abuja na e him hear say flood don reach e house before e go come back to Bayelsa flood don dey window level of e house,all the money don cast. Na wetin lead to him death. So the redesign go help small

Yes na di true be that, na dem bi di arm robbers with briefcase and suit. Nigeria get money die. If di politicians dey spend di money wey dem dey steal for we kwantri sef, money gede flow reach all corners but dem dey hide am till spoiled. Di flood really spoiled things in Bayelsa but I no hear dat story. Though dis days I no dey watch news again like that. In my own discovery of the flood matter, those who were really affected were not given any palliative but those who were not affected much were receiving donations from internal and external donors. Di amount Goodluck received from internal and external bodies were much more than even even the state allocation.