Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 2 from 1 user
Re: Nigeria (Naija)
by
Maestro75
on 01/12/2022, 16:52:18 UTC
⭐ Merited by CryptopreneurBrainboss (2)
I for like shook mouth for this matter but your reply don already do justice to wetin the user talk. Well done. Make we still talk about bitcoin and bitcoin development for Naija because whether na Peter Obi win or na Atiku or Tinubu, if we nor hustle hard nobody, not even their proposed policies go fit help us.

Abeg I wan ask anybody here don notice say Remitano dey freeze or e dey too slow? And which other alternative dey aside Binance wey person fit to use? Una Doh

If nothing don teach you anything, wetin happen during #endSARS supposed teach you small thing about these politicians in authority. You see how Buhari take order banks to freeze accounts weh get crypto trades on them or you don forget? Those weh we elect into office get so much to do with how we progress or not. If you elect a nonsense or weak leader it will affect us too. Is the choice of Buhari not affecting all of us now? If you like hustle reach tomorrow and the leaders make policies weh go affect you, there is nothing you can do. So we have to get it right. This politics get weight pass our economy self because na politics deh control economy. Make una no deh see as say any discussion on this election na distraction. It is not a distraction. Na the main thing be that.