Abeg I wan ask anybody here don notice say Remitano dey freeze or e dey too slow? And which other alternative dey aside Binance wey person fit to use? Una Doh
If you no wan use a completely decentralized P2P due to the risk of getting scam and you wan dey use this centralized P2P wey we dey manage for Nigerian then try Kucoin, OKX, Houbi or paxful exchange or other centralized exchange wey get P2P option. Dem plenty oh no be only Binance and remitano dey offer such trading options. Another thing na to just run the transaction with another merchant wey you know wey dey into P2P trading and e for save you all the stress of going through this centralized platforms.
Based on our discussion last month, the poll dun close and na the i'ss have it. At the end of the month like dis when this analysis dun come out by our brothers Igehh and uchegod-21. The top three quality posts go received an award of 10 merits to be shared as follows; 50% for 1st position, 30% for 2nd and 20% for third. Initial budget na 10 merits but e fit increase if enough smerit dey my hand by the time the stats come out. Others fit follow this same rewarding criteria and make all the meriting happened for the local board posts of the winners wey dem make that means you gas review the account. Hopefully this go increase the quality on this thread and more engagement.