Unto tinubu matter sef kwa, the man don old too much to go for 001 office. That office no be only for the old men Dem wey don dey rule us for long. We need fresh vibrant leader in the government.
If our country na where people deh do things well and from their conscience, all the old politicians for don know say them no fit cheat anybody enter that seat. Leave Tinubu, him think say his bullion van go rescue am this one. His eyes go clear. Wetin happen for Osun go happen again for national level.
Like dis I wan use this opportunity call on all my brodas and sista Dem inside the forum to join me celebrate as today na my convocation for the university of Port Harcourt wey mark am say true true all don really don and dusted. The journey be no easy but baba God make am possible
https://i.imgur.com/wxjJoXe.jpegCongratulations my brother. But why you hide your face for that pix? Make you no loose guard sha by looking for job after service. Start from this forum and pursue your dream well. No expect any uncle or aunty to fix you someone. Jobs no deh but they will lie to you say dem deh do something. Crypto has been saving lives since 19 00.