Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigeria (Naija)
by
Frankolala
on 02/12/2022, 19:48:39 UTC

Like dis I wan use this opportunity call on all my brodas and sista Dem inside the forum to join me celebrate as today na my convocation for the university of Port Harcourt wey mark am say true true all don really don and dusted. The journey be no easy but baba God make am possible

https://i.imgur.com/wxjJoXe.jpeg

As baba do am for me na so him go run am for every other person in their own different expectations.

My broda congratulations on your convocation oo. Omo e no easy for the our country at all. To enta school  na one thing anoda thing na to finish especially for people wey no get any body to back dem up. Omo as i dey see people dey graduate i just dey say na only God nai dey do am for person. Me too i dey hope to go round up my studies very soon, because of  bills and the struggle e no easy for the bele kingdom i had to pull back for my year three @M.A.U and try gather small funds to meet up, but as you talk na oluwa dey run am and i go finish am very soon one-day and my prayers too be say make we all change so that dis our country go good because na all of us follow dey spoil dis country , one man go only start the change but na we all go complete the race
@ Lida u don achieve one purpose of life and I congratulate u for this,e no easy with all ASUU strike and FG issues on settling ASUU,u still cross make u no go think say u don arrive o bcos na now d hustle don start for u as u dey on OYO now. Parents go hardly give u cash for your up keep,na u need to face and overcome the joblessness wey the country put us for.

To be a man no easy o,so put God first for your hustle and e go clear road for you. The highest work dey inside this forum if you code the code.