Like dis I wan use this opportunity call on all my brodas and sista Dem inside the forum to join me celebrate as today na my convocation for the university of Port Harcourt wey mark am say true true all don really don and dusted. The journey be no easy but baba God make am possible

As baba do am for me na so him go run am for every other person in their own different expectations.
Congratulations on your graduation boss. As you take finish your school, I pray better job locate sooner than you expect. Na favor market no be labor market you go enter. Amen to your prayers bro. Me sef wan graduate after seeing shege from Corona and ASUU strike, spent six and half years and still counting for a four year course... Omo!