Like dis I wan use this opportunity call on all my brodas and sista Dem inside the forum to join me celebrate as today na my convocation for the university of Port Harcourt wey mark am say true true all don really don and dusted. The journey be no easy but baba God make am possible

As baba do am for me na so him go run am for every other person in their own different expectations.
Congratulations my brother. Em no d easy to graduate from Nigeria university this days. For peso to graduate for Nigeria university na must sae em go experience months of Asuu strike, you go witness cultist wahala, or even lecturers wahala. When I hear or see peso wey I know graduate from Nigeria university, I do give that peso thumbs up cos em no d easy at all cos I know how em be to pass through the four corners of education for Naija.
As em be so, as you take graduate. Just find better handwork to learn, coupled with this our forum d do wella until you begin reason for NYSC service year by next year.
Together Nigeria go better for you and I by next year when we elect the right president to rule our able country "Nigeria''