Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigeria (Naija)
by
CryptopreneurBrainboss
on 03/12/2022, 05:18:58 UTC
Like dis I wan use this opportunity call on all my brodas and sista Dem inside the forum to join me celebrate as today na my convocation for the university of Port Harcourt wey mark am say true true all don really don and dusted. The journey be no easy but baba God make am possible

As baba do am for me na so him go run am for every other person in their own different expectations.

Why u no put us on, on time make we turn up for the occasion, list this ehh I wan just dey chop rice for occasion for this period as na celebration month na e we dey so. So any occasion wey dey, no hold back, invite the house and we go mobilized come turn up and celebrate with you or any other person wey dey celebrate. I wan use this great opportunities congratulate you on your graduation. It's a thing if joy and I celebrate with you and wish you more joy proceeding this current one. Like dis now you dey ahead of ur mates as you get this place. You no go need stress yourself as here herself na oil industries. Just put your head for ground, hustle and one dey you go dey enjoy payout wey no government job fit deliver.

Quote from: Majestic-milf
E dey pain me say up till dis time, we still get pipo wey dey sentimental about this election and d candidates
E good say we sopoz vote who go carry is jakpa from dis mess wey our past leaders and current leader keep us, but e no go make sense if we dey particular about a candidate, because if no be God wey help, we fit still go vote another wolf in sheep's clothing.

One thing about life na say, we get two opposite sides for any thing wey dey happen here. You see as majority of us see shege for this governments, e get others wey flex am as things been stew for them. Telling those people to vote out APC go hard as na there them dey chop. No go force your candidate on anybody remember say ones we been believe in Buhari but see as e turn out. Make we just hope say anybody wey win go pity us and do things right so the whole Nigeria fit smile small as we dun too surfer.