One thing about life na say, we get two opposite sides for any thing wey dey happen here. You see as majority of us see shege for this governments, e get others wey flex am as things been stew for them. Telling those people to vote out APC go hard as na there them dey chop. No go force your candidate on anybody remember say ones we been believe in Buhari but see as e turn out. Make we just hope say anybody wey win go pity us and do things right so the whole Nigeria fit smile small as we dun too surfer.
Omo no be small suffer my brother things wey people don see for this country no be small, i no dey fit chop sardine again sef cos the way tins don dey somtin 150n dah year don ton 800n. Sha as you talk am na so e be oo, as many people dey hunger and suffer na so some people just dey panya for inside the suffer wey you dey suffer.
Just take for example person wey him people dey show am love well and him people get appointment for the Apc government you no go dey expect the person to come go vote another party wey him no know wetin go sup after.
But one thing wey still dey worry me be say na all this party nonsense wey people dey talk sef . Imagine the election wey happen for my state for last governorship election for bayelsa between David Lyon(apc) and douye dire(pdp) ,for once bayelsan decided to vote another party because of the love wey dem get for the apc candidate and the fact say the ex governor be wan kill people with him followers for their tenur to even pay salary that time na big problem and when election time reach wey the pdp politicians see the love for the apc man na so all of them start to run come enta apc again to continue the ruling and to corrupt this man wey people get for mind.
So the whole thing na just one funny circle