Dis won na gud won bcos e bi like sae di Government have it in their mind even though dem neva approve am. But how dem wan do am wey bi sae dem won create jobs from crypto through taxation. Di mata tire me. Onli dis year dem don promise Nigerians on cryptocurrency plenty times but nothing don Happened. Di thing don enta politics.
Naija nai make i jus like dis countri. I tink say na dem ban crypto for the country e no end dear dem even block plenty people fiat bank account wey get any connection to do wit crpto, me sef i be victim of the block. Dem freeze ma bank for no reason during that time of the crypto ban and when i even reach bank to ask why dem talk say na account whey dey transact wit crypto. Now all of a sudden the same government don dey say dem wan train people for blockchain technology as dem don see the plenty moni wey dem get from taxin transaction with crypto and so many promises wey we don suppose dey use to now. As for politics e no suppose dey new na. na d normal trend for the counkri be dat even flood sef dem tun am to politics dey pack plenty moni wey dem suppose give people wey dey affected