Di thing don enta politics.
Me just dey laugh una wey still dey carry mind face for Government and dia promises, see like dis my mind don strong and I no too reason government bicus dem be the biggest scammer we get for dis we country so e beta say una remove mind make we join hand put pesin wey go do us wella dan to dey see promise and fail everi 4 years to 8 years.
My broda you see this our country anything wey concern government just know day politics must dey inside am, cos already na wetin dey government dey take live by. Just imagine how them use ASUU head take play politics telling them make them go back to classroom and start teaching say them go pay them all the money in arrears for the 7months sef wey Dem no work go work sake of dey strike. ASUU rush call off strike Las Las government change mouth say na month wey Dem work na Dem go collect salary based on no work no pay clause. People wey no get Masters/phD na com dey use/scam people head wey claim say Dem be Prof with PhD.
If u no fear this our country politicians den I wonder who person go fear again.their mouth na black and white person no fit knw wen Dem dey even talk truth again.