Government wan begin dey tax crypto transactions
My people I listen to channels TV and them report say the government dey look into taxing crypto transactions and digital assets. Madam Zainab wey be finance minister say the go go through FEC before the president go forward am go Green and Red Chamber for approval. The way things they go recently he be like we government Don dey fall in love with crypto oo abi dem just dey feel say no matter watin dem do people no go leave the crypto so themselves they follow trend.
Abi them wan use this one take consol Nigerians base on election wey dey come? Since plenty youths dey into this stuff.
My people I wan here una view how una see this move?
Moreso he be like dem NITD Don shortlist people wey dem carry for this blockchain tutorial dem. If you apply just check your mail to see
You see this our present government, no belief anything wey d sae until the implement am immediately. Shey you been see how the take ban trading crypto that year with banks. You also see how the take announce am that day for news, the next day d implement asap. Why don't they do the same with this one now? They wan try to follow the duo process to implement am. Wetin d showcase with this dia move, make em be sae dem no d against crypto.
It's remaining 2months to the end of their tenure, they wan to the try form good make people clap for them. Abegy make them shift one side, make we see wetin our next President go be gets in stock for Nigerians.
Me wey share the information about NITD I no get any email sha

anyway congrats to people wey receive the email from them. I wish una luck for the training
Nigeria government na them be scammers, na e make scam full Nigeria because the government dey promote scam. Them go lie give u so that make u do something wey go benefit dem and at the end wetin dem talk no e them go do. The difference between yahoo boys and them b say,government dey use authority dey scam you,and you no go fit do them anything because nobody fit win government.
If na yahoo boys, na still dem government go, go catch am becos e do wetin dem no go fit do without power, so dem go come envy. Just check out the bodi EFCC na dem be Nigeria legalize criminals. I no go believe everything wey this our government go tell me till I die only if good people come into power because e just be like say dem dey carry people play. All these wey dem dey talk or do now na election saga. Make dem cari their lie lie comot for sit make we see the next person wey go enter jor.