We never even get our local board we don already dey discriminate some posts as low quality. We fit no understand wetin wan happen, but I don see am say e no go help us at all. E no compulsory say na bitcoin we go dey talk here.
If you check well Theymos himself no dey add anything wey go limit anybody. And I suggest say make we no suffocate here with rules.
When it comes to the filtering out the political posts to determine the winners, I just dey wonder how Igehh go do am. Sha make we dey watch, na trying phase we dey like dis, no worries we go surely get am right one day
Me no like how Igehhh want to begin screen political posts. We sabi say him na APC member and him fit to deh use that opportunity deh cut off posts on APC weh him no like. Me no give a damn about any of the parties. Na personality i deh look. I deh pity anybody weh deh support based on party line because all of them don fail us. But for those weh deh support a sick man to be president of this country wetin una see for the matter weh me no understand, abeg una fit tell us wetin deh?