I still dey chuck mouth for this matter because I know wetin dey at stake. I don already see front. In the other hand I fit still dey wrong. But I just believe say the main thing for us na make we no begin put rule for
thread wey no be
board. This thread is self moderated, the OP wey be CryptopreneurBrainboss fit set rules on wetin be spam, and if anyone default, em post go delete. ThankGod him dey active for this thread. The last time I check, our problem no be post quality because Nigerians na quality posters.
Na this kind statement below dey make me dey more skeptical. If you no know how Igehh go do the matter, mean say plenty people no go know too.
When it comes to the filtering out the political posts to determine the winners, I just dey wonder how Igehh go do am. Sha make we dey watch, na trying phase we dey like dis, no worries we go surely get am right one day
Oya, see another dimension person don go. Him don dey already align the matter to political affiliations.
Me no like how Igehhh want to begin screen political posts. We sabi say him na APC member and him fit to deh use that opportunity deh cut off posts on APC weh him no like. Me no give a damn about any of the parties. Na personality i deh look. I deh pity anybody weh deh support based on party line because all of them don fail us. But for those weh deh support a sick man to be president of this country wetin una see for the matter weh me no understand, abeg una fit tell us wetin deh?
Me for like the activity things only o... if you think say e go increase spam share the merits 2 for the first 5 people making it 10.
The original idea wey make me begin drop statistics here na to increase activity. Make we no come create problem wey no dey, come dey find how to solve the problem we create. I don talk my last for this matter, anyways poll don dey shaa.