Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigeria (Naija)
by
Maestro75
on 08/12/2022, 07:36:43 UTC

Boss man Igehhh, nothing deh drive my inner motivation except say I just deh only state the matter as I see am. You for expand the number of monthly posts on politics to 20 and see if people no go choose that option.

I still dey chuck mouth for this matter because I know wetin dey at stake. I don already see front.  In the other hand I fit still dey wrong. But I just believe say the main thing for us na make we no begin put rule for thread wey no be board. This thread is self moderated, the OP wey be CryptopreneurBrainboss fit set rules on wetin be spam, and if anyone default, em post go delete. ThankGod him dey active for this thread. The last time I check, our problem no be post quality because Nigerians na quality posters.

Na the problem be that. Any where weh restrictions deh, e deh make some people feel cheated. Ok, if we say we no want to deh count more than 7 posts monthly on politics, what about posts weh no even get anything to do with bitcoin or economy? Another thing be say this politics weh we deh try clamp down on its post count na him deh even control whatever happens with bitcoin and the economy, anyhow weh una look at it.