Make una use the poll, many people no go fit air their views as e go belike dem dey attack each other so with the poll anonymity dey granted. Political Bitcoin related discussion na wetin we dey talk here right 4rm time and that isn't what is been kicked against (so the community isn't confused), what is been kicked against is, will mr A win or Mr B win etc and all those campaign related posts are making the thread look messy. If any news about the currency or Bitcoin is discussion then we can bring that discussion to the thread. If them pass bill wey go affect we nation or targeted at the Bitcoin community we fit bring am here discuss.
This thing nor too hard like that sha. If we dey struggle to get Naija Politico-Bitcoin use na check this website - Nairametrics. Them get better up-to-date financial, investing, and business news, research-based content, financial literacy, and personal finance resources.
NEWS UPDATE: House of reps orders CBN to halt new cash withdrawal limit
The house of reps no gree at all about this recent infoment, and as a result them don order CBN to stop the implementation of this new policy and them don send the CBN governor Godwin Emefiele letter make him appear before the house on 15 December 2022, make him come torchlight about the new policy and tell them why dem go allow am to stand.
The House of Reps nor fit do anything. Where dem been dey when oga Meffy, walker with him too legs go meet our Presido? Where dem been dey when them do the launch? Nor be because say dem see say dem nor fit benefit from am na him make them one be like say dem one fight Oga Meffy? Well, I dey monitor them closely sha but in my estimation dem be toothless bull dogs.